fbpx
May 18, 2024

NASS and CBN dey drag over old naira notes deadline

nass-and-cbn-over-old-naira-notes-deadline

Di two arms of di National Assembly, di Senate and di House of Representatives, yesterday ask di Central Bank of Nigeria, CBN, say make dem extend di deadline for di usage of old naira notes beyond di January 31 target wey di apex bank don set.

As di Senate ask say make dem extend di deadline July 31, di lower chamber yarn say make dem extend am to June.

But di governor of di CBN, Godwin Emefiele, yesterday , yarn say di January 31 deadline go remain as e dey.

Di Senate for di plenary yesterday follow advise CBN ay make dem open exchange window where people without bank accounts fit deposit dia old notes.

This resolution of di Senate na because of di motion by Senator Sadiq Umar, APC, Kwara North, wey demand di extension to July 31.  Hin bin yarn say hin dey worried as di apex bank no wan extend di date of di deadline.

FOR MORE NEWS: This country economy go suffer as CBN no gree shift di deadline – EXPERTS

You fit remember say on October last year, CBN yarn say di old naira notes no go be legal tender as of January 31, but di Senate bin don dey advise di apex bank since December say make dem extend di deadline to June 30.

Upon di whole tok and advise, di apex bank till no gree extend di date.

Umar, dey lament say di new note no dey enough in circulation, and di apex bank suppose extend di deadline to July 31.

Dem dey tok say di timing of di deadline to phase out old naira note no make sense.

Di matter full ground, you fit go read di full tori…READ MORE