fbpx
May 18, 2024

“E still dey haunt me” – BBNaija S4 star, Ella, call out colleagues, Mercy and Venita over matter wey dem no settle

ella-don-call-out-her-colleagues

Former Big Brother Naija “Pepper Dem” housemate, Ella, don call out her colleagues, Mercy Eke and Venita.

Ella, wey be housemate for di fourth season of di reality TV show, inside Instagram live session on Tuesday night, April 11, finally address di drama between herself, Mercy, and Venita during di reunion show for 2020.

Remember say on di reunion show three years ago, as Venita make reference to how Ella pull stunt on dem regarding her mama health, she describe Ella as “a deceitful liar and beggar with bipolar disorder.”

Mercy Eke, on her part, ask Bella say wetin she dey do with her resources and if she dey do drugs.

FOR MORE NEWS: Wike vs Dino Melaye: Wetin to expect soon – Atiku camp don replies Rivers gov

“What do you do with your resources, do you do drugs?” Mercy Eke ask di question. However, na Ella reply be dis; I use my resources to take care of my mum”.

Three years don pass since di event, but last night during an Instagram Live session, Ella vex call Mercy and Venita out for di offensive comments wey dem make during di reunion.

She add say even though na three years, Mercy question about whether she dey do drugs and di remarks wey dem make still dey haunt her.

She demand for public apology from di ladies to right dia wrongs.

You fit go read di tori as Ella don call out her colleagues…READ MORE