fbpx
May 19, 2024

Ebonyi govt don begin upgrade of Airport runway

ebonyi-upgrade-airport-runway

Ebonyi State government wey Governor Francis Nwifuru dey lead don start di upgrade of di Chuba Okadigbo Airport runway to international standard.

Di State Commissioner for Aviation and Technology, Mrs Ngozi Obichukwu yarn say dem don agree to upgrade di Airport runway.

Also, Obichukwu yarn say di upgrade of di runway, from concrete to standard asphalting, na to enhance di operation of foreign airlines and other flights movements for di airport.

Di Aviation Commissioner, wey assure foreign airlines and travellers of adequate protection and safe landing for di Airport yarn say di runway na concrete, no be asphalt.

However,  na why di Governor Francis Nwifuru quickly send experts wey get knowledge for di construction of runways to see how dem go fit upgrade di runway international standard.

 

FOR MORE NEWS: Akwa Ibom Assembly dey investigate claim of unlawful sack of five polytechnic workers

 

In addition, hin tok say di expatriates dey work hard to make sure say di runway meets international standard. Hin tok say di United Nigeria Airways bin land there and dem request for di upgrade of di concrete to standard asphalting.

As di matter be so, Governor Francis Nwifuru don open discussion with China Civil Engineering Construction Corporation, CCECC and CDC construction companies. Hin wan make sure say dem upgrade di airport to international standard.

You fit go read di tori…READ MORE