fbpx
May 18, 2024

Actor Bolanle Ninalowo don announce di end of hin marriage to wife, Bunmi

bolanle-don-end-hin-marriage

Popular Nollywood actor, Bolanle Ninalowo don enter social media announce di end of hin marriage with hin wife, Bunmi.

Inside post wey hin share on top hin Instagram page, di 43-year-old actor yarn say dem decide to go dia seperate ways because of matter wey dem no fit settle, but hin no provide more details.

As hin share heartbreak emoji, Bolanle, wey buy house for hin wife for US in 2022, write say hin don finally accept di reality of di End to a Road!
As Bolanle don end hin marriage, hin tok say na sad reality wey go give room & hope for a brighter and more fulfilling future!

 

FOR MORE NEWS: “Fear men” – Chisom Steven reveal few days after Traditional wedding

 

Hin tok say na reality wey dey SAD for hin loving and adorable children but necessary for peaceful and loveable future.

For di end of di post, hin ask fans make dem respect hin privacy and pray for dem during dis process as dem try to heal and move on with dia independent lives even as dem go dey take care of di wetin dem love most, dia children!

Also, hin tok say hin dey Heart broken but hin no dey broken. Hin write say hin still stand tall as hin break di sad but true news to di same world wey adore him and hin beautiful family.

You fit go read di tori…READ MORE