fbpx
April 20, 2024

EPL: Chelsea legend tell Potter best position to play Mason Mount

0
Masin\Mount\

Chelsea legend, Gus Poyet, believe say di best position for Graham Potter, di club new manager, to play Mason Mount for di Blues’ squad na for am to stay close to the strikers or the box. Poyet see Mason Mount as one of those players wey need to step up hin performance so that he go  help Potter turn Chelsea form around.

YOU STILL FIT ENJOY THIS ONE: Barcelona don terminate Braithwaite contract

Poyet tok say Mason Mount, for hin opinion, and respect to di coaches, Mount suppose get one position for di team and he suppose play 90% of di time for that position.

He tell Midnite say when dem get player like that wey fit play for different positions, e go dey hard for am to play at hin best. When Mount play near where di strikers dey, close to the box, Chelsea go get big chance to score goals. He tok say na hin humble opinion be that.

You fit go read more of di tori, CLICK HERE.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *