fbpx
April 29, 2024

EU Don Offer $3.4mn Solar Grid Facility For 76,000 Beneficiaries For Nigeria

Eskom.-Battery-Storage.-Bigstock

Di European Union(EU) don give approval for $3.4 million working capital facility under di ElectriFI Country Window for Nigeria for Okra Solar to use solar mesh-grids target 76,000 energy access beneficiaries by di end of 2025.

Okra Solar go provide access to electricity through mesh-grid technology to mini-grid developers.

Di initiative, wey dem launch in 2016, Okra Solar develop di mesh-grid technology specifically to electrify underserved or unserved communities.

FOR MORE NEWS: EFCC recover N13bn illegal fuel subsidy payments

Dia proprietary Okra Pod na device wey dey allow di installed solar systems for each household communicate and share power through low voltage transmission cable (creating di mesh-grid). Dem dey sell di pods with PV panels, battery and inverters.

Di company don dey focus on di highly strategic Nigerian market and dem wan deploy multiple pilot projects wey go energise more than 30,000 households for dicountry over di next two to three years.

You go like read di full tori…READ MORE