fbpx
May 14, 2024

EU report no fit tell us who win election for Nigeria” – Keyamo

EUOM-no-fit-tell-who-win-election

Festus Keyamo, a spokesperson for di bygone Tinubu/Shettima Presidential Campaign Council, don tok say di European Union Observer Mission EUOM 2023 general elections report no be document wey fit tell who win di election for Nigeria but na just report of di ‘irregularities wey dem notice and recommendations for improvement in future elections.

Recall say di EUOM, inside dia report less than a week ago, point out some flaws for di general election and dem make recommendations to di Independent National Electoral Commission, INEC

Keyamo, a Senior Advocate of Nigeria, SAN, as hin dey reacting via hin official Twitter page tok say no election worldwide dey happen without irregularities.

 

FOR MORE NEWS: JAMB vs Mmesoma controversy don show say 2023 elections divide Nigeria – Omokri

 

He explain say di issue na whether di supposed irregularities affect di election outcome.

According to am, di EU report no be document wey go tell who win or lose election.

Remember say INEC bin declare Tinubu, di winner of di presidential election.

However, Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party and Peter Obi of di Labour Party dey for di Presidential Election Petition Tribunal, to challenge di victory of Tinubu.

You fit go read di tori see as Keyamo tok say EUOM no fit tell who win election…READ MORE