fbpx
May 8, 2024

Exchange rate: NECA and experts dey disagree on top FG target.

experts-opinions-on-rxchange-rate-target

Lagos — As we dey hear say Federal Government dey plan measures to achieve exchange rate target of N500-N600/$1, and dem wan reorganize the banking sector, different private sector institutions and financial experts don about their own different opinions on top if e fit happen and the better way wey e go fit help us.

“Dem still advise government on wetin dem suppose do to make the economy stable so that e go fit tackle the wahala wey dey with the exchange rate.

Special Adviser to the President on Economic Matters, Dr. Tope Fasua, talk this one for the “Cowries to Cash” lecture wey dem launch for Abuja on Tuesday. Also, e yan say Federal Government dey plan to boost the value of naira.

In addition, e follow yan about the way naira value don dey rise for some days now. And e yan say dem go continue to rise because government dey put policies for ground.

E come dey yan Nigerians wey dey hide foreign currency dey hope say our own money go dey fall. E yan dem say government policies go shock dem.

 

FOR MORE NEWS: Supreme Court no confirm Tinubu as winner of 2023 election – Datti Baba-Ahmed

 

Fasua, wey represent Vice President Kashim Shettima for the event yan say, “For those wey dey speculate and dey pray say our money go lose value, I believe say the policies wey Central Bank and Federal Government dey put for ground go shock some of them.

“You sabi, we get great ideas wey dey come up. Some of them wey dem don start don dey change the way naira dey lose value, and e give us target say make we look forward to many of them. For example, the one wey we talk say Nigeria economy go reach one trillion dollars, e wan make e happen by 2026.

“Some people think say naira go dey lose value, but of course, we don dey see wetin dey happen and naira go still strong reach N500 or N600. I dey see some of them.”

Plenty tori dey on top opinions of experts about the rate target, make you waka go READ AM HERE