fbpx
April 20, 2024

Expose criminals and other bad people, collect 50k – Gov Akeredolu

0

Ondo Governor Rotimi Akeredolu don call on residents of the state say make dem no dey keep quiets when dem get information for hand, that if anyone get correct information concerning Kidnappers and other Jaguda people wey dey the state, say make talk out and give the information to security agent.

He yarn say, as people dey talk about these kidnappers and other bad bad people for the state, this go help stop insecurity matter for the State, and expose criminals dem wey dey Ondo communities.

He add join am say, this kindly assignment no be for free, say anyone wey carry better information give security agent for the State, say him promise to dash the person N50,000 for providing information wey fit help us gbab bad bad people for Ondo State.

Ademola-Olateju wey carry the matter come journalist front after the weekly State Executive Council meeting yarn say, the step nah to encourage citizen, so that dem go fit dey give timely information about criminal activities in any part of the state.

From now on anybody wey drop correct information wey go help gbab bad bad people for the State, that people go collect N50,000 reward.

So, anytime and day, if you get correct information for hand, hurry call this number “The Toll-Free line is 0800-555-5555. Also, we go make sure the person wey carry the information come, bin dey anonymous, so that nobody go fit no-where the information come from.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *