fbpx
June 17, 2024

“Na poor polygamist una hate, no be polygamy” – Reverend  Father Kevin Ugwu don tackle Nigerian ladies

father-kevin-blast-ladies-on-polygamy-matter-

Popular priest, Reverend Father Kevin don comes for ladies wey claim say dem hate polygamy but dey wish say dem be di seventh wife to famous billionaire, Ned Nwoko.

Di businessman dey famous for di six wives wey hin get; di sixth and current last wife, na hin be Regina Daniels. From how everything take be, e be like say hin favorite be Regina Daniel, na why hin continue to dey spoil di actress with plenty gift in form of money.

She bin don announce on Thursday 26 January say her husband gift her 100,000 dollars.

This kain thin na hin some of Nigerian ladies dey like about di rich polygamous men, some ladies even openly express dia desire to Ned Wife too.

Father Kevin react to this trend for social media, hin blast those ladies for wey dey claim say dem hate polygamy but dem wan dey for Regina Daniels position.

FOR MORE NEWS: “Na market she dey sell, acting no dey pay” – Fans don tackle Eniola Badmus over outfit wey she wear go campaign

According to wetin hin tok , di thing wey ladies no like no be  di  practice of Polygamy  itself but na poor and broke penniless practitioner of polygamy na hin dem hate.

Na wetin hin tok be this;

“THOSE SHOUTING THAT THEY HATE POLYGAMY ARE NOW WISHING TO BE NED NWOKO’S NEXT WIFE. SAY THE TRUTH AND NOBODY WILL BEAT YOU, WHAT YOU HATE IS NOT POLYGAMY BUT POOR POLYGAMISTS. WHAT YOU ABHOR IS NOT OLD MEN, BUT POOR OLD MEN.”

You fit go read di full tori…READ MORE