fbpx
June 17, 2024

“Na market she dey sell, acting no dey pay” – Fans don tackle Eniola Badmus over outfit wey she wear go campaign

eniola-badmus-campaign-outfit-don-make-fans-dey-tok-

Nollywood actress, Eniola Badmus don continue to face backlash after she openly express her love and support for All Progressive Congress Presidential candidate, Bola Tinubu. Di outfit wey di actress Eniola Badmus wear go campaign don make fans dey tok.

Di actress sudden weight loss bin follow make headlines last year 2022. After she post photos and videos of herself and other party members after dem finish dia campaign for di university. For inside di photos, she wear black Bikers Short go di event.

However, di photos and videos bin no go down well with some of Eniola followers for Instagram. All of dem express dia disappointments via di comment section.

Meanwhile, all di fans wey no happy, start to dey wondey weda Eniola Badmus get ulterior motive as she take get mind wear that kain outfit go campaign

FOR MORE NEWS: Shanty Town: “Naked Scenes Bin Dey Inevitable” – Ini Edo Don Tok

Na her caption for di Instagram post dey below;

“EARLIER TODAY WITH THE LAGOS STATE GOVERNOR @JIDESANWOOLU AND THOUSANDS OF LAGOS STATE STUDENT OF ALL TERTIARY INSTITUTION WITH UNIVERSITY OF LAGOS CONVERGE TOGETHER TO ENDORSE @JIDESANWOOLU AND HIS DEPUTY @DROBAFEMIHAMZAT FOR 2ND TERM WITH @OFFICIALASIWAJUBAT FOR PRESIDENT AT THE MOBOLAJI BANK ANTHONY SPORT ARENA,” SHE CAPTIONED THE IMAGE SHARED.

Fans comment for di posts and na dia reaction be this;

Florence Gabriel write: Why does she wear tights to all the campaign grounds? Not even a trouser at least dress responsible abi you dey look for governor wet u go collect ni?

Another user write: Na market she dey sell, acting no dey pay. She needs money to maintain surgery process.

You fit go read di full tori…READ MORE