fbpx
May 18, 2024

“Nigerian artistes get great platform today because of Fela” – 9ice

fela-make-nigerian-musicians-succeed

Legendary Nigerian singer, Alexander Abolore Adegbola Akande, wey dey popularly known as 9ice, don tok say na late Fela Anikulapo Kuti na hin make Nigerian musicians get di chance to succeed.

Inside recent interview with Sis Project Studios, di “Gongo Aso” hitmaker yarn say Fela, di father of Afrobeats, present genre wey make things simple for plenty artists wey dey try new things and dey find method to show di world dia abilities.

He add say di Afrobeats teach am plenty things and hin dey happy say hin dey alive to learn wetin di great pipo don do.

 

FOR MORE NEWS: Nigeria 4.1 per cent unemployment rate don divide experts

 

For inside another news, Grammy award-winning Nigerian singer and songwriter, Temilade Openiyi, wey dey professionally known as Tems, don tok about her di difficulties wey come with fame and success also,  she reveals why she switch from Afrobeats to RnB.

Inside interview wey bin dey included for di most recent issue of Interview Magazine, she discuss plenty topics with American rapper Kendrick Lamar.

Tems yarn say success dey always come with plenty demands and difficulties, but she go dey try to get over dem by being herself.

You fit go read di tori see why 9ice tok say Fela make Nigerian musicians succeed...READ MORE