fbpx
May 9, 2024

Nigeria 4.1 per cent unemployment rate don divide experts

nigeria-unemployment-figure-dey-cause-disagreement

Disagreements still dey follow Nigeria 4.1 per cent unemployment figure inside dis economic hardship wey fuel subsidy removal and di foreign exchange crisis don cause.

You fit remember say di National Bureau of Statistics on Thursday last week reveal for dia recent Nigeria Labour Force Survey say di kontri unemployment rate na 5.6 per cent for Q4 2022 and 4.1 per cent Q1 2023 using di revised International Labour Organization methodology.

Di recent figure dey come after two years of living without unemployment figures. Also, di last time wey di National Bureau of Statistics release labour data na 2020, and e stand for 33.3 per cent.

 

FOR MORE NEWS: Transfer: Leicester City want £18m for Iheanacho

 

As di matter be so, di 4.1 per cent unemployment rate means say na only four of every 100 Nigerians dey unemployed.

For some Nigerians, di Nigeria unemployment figure don bring up some kain feeling because di 4.1 unemployment rate no match reality.

Also, di announcement of 4.1 per cent unemployment rate for Q1 2023 don meet mixed reactions Nationwide.

Di figure dey different from di last official data of 33.3 per cent for Q4 2020, wey dem release in March 2021.

You fit go read di tori…READ MORE