fbpx
May 17, 2024

2023: Endorse di “Devil” you know, Shehu Sani tell Wike and hin G5 led govs

Shehu Sani don come out tell wike and hin G5 led governors of di Pipol Democratic Party, PDP, to endorse di “devil” dey know by 2023.

Di former Senator Shehu Sani don suggest di best candidate for dem to support.

U FIT ALSO READ Secondus no finish secondary school, hin no be member of PDP – Wike insist

Since Nigerians dey await di decision of Governor Nyesom Wike of Rivers State- amd hin led G5 governors on the choice of presidential candidate.

Sani yarn dis one inside one of hin tweet as hin write say: “G-5 Governors should endorse ‘the devil’ they know and not…“The nation is blessed with Presidential candidates with democratic credentials and history of tolerance to political criticism, political opposition and political dissent. We don’t need an autocrat allergic and hostile to different opinion

Since Wike-led group dey against di PDP presidential candidate, Atiku Abubakar over zoning pattern inside di party and dis thing don cause a lot of gbege for di party.

Wike and hin G5 group, don refuse to campaign for Atiku, base on say dem tok say di North no fit produce Presidential flagbearer and at di same time produce National Chairman for di party.

Di G-5 group comprises of governors from Benue, Oyo, Enugu, Abia, and Rivers State, as dey don demand for di resignation of Iyorchia Ayu as PDP National Chairman.

To read di full tori CLICKHERE