fbpx
May 18, 2024

Peter Obi don react to Alaba market demolition by Lagos govt

obi-react-to-alaba-demolition

Mr Peter Obi of di Labour Party, LP, don react to di recent demolition of some buildings for di Alaba International Market by di Lagos State Government.

Obi yarn say although some of di demolitions fit dey excusable, dem don leave plenty victims, mostly ordinary pipo ill-informed or misguided.

He yarn say di primary duty of any government na to care for and protect di citizens.

Recall say di Lagos Government on June 16 start di removal of wetin dem describe as distressed buildings for di Alaba International Market wey dey for Ojo Local Government Area of di state.

 

FOR MORE NEWS: “If I marry and my husband cheat, I get access to slow killer poison” – Pharmacist don tok

 

According to the report, di enforcement team of di Lagos State Building Control Agency, LASBCA and di Lagos State Task Force embark on di joint exercise.

Following di controversy wey trail di exercise, di government insist say di exercise na measure to prevent disaster.

However, Obi maintain say Nigerian citizens no need to dey subjected to di additional stress of unexpected hardship.

Also, hin yarn say necessary corrective measures to planning or zoning violations by governments no suppose dey insensitive.

In addition, hin tok say for Nigeria, we dey live for time of extreme difficulties for citizens because of stagnated income, inflation, huge unemployment and high costs of living.

You fit go read di tori see Obi as hin react to Alaba demolition…READ MORE