fbpx
May 20, 2024

FIFA picks Morocco to host 2023 Club World Cup

0

FIFA don select Morocco to host di 2023 Club World Cup for February, as dey don readi to expand di 32-team edition wey dem go launch for 2025.

FIFA President, Gianni Infantino, make di announcement on Friday. hin tok say di tournament go take place from February 1 to 11, 2023, Infantino yarn dis one to tori pipol inside one press conference for Doha.

U FIT ALSO READ Algeria don show interest to host 2025 AFCON

European champion Real Madrid, South American champion Flamengo and Seattle Sounders, the first CONCACAF Champions League winner from di United States, go also play for di seven-team traditional tournament.

Base on wetin Morocco do for di ongoing World Cup for qatar bifore france beat dem comot for semi-finals, FIFA con decide say dem go use am compensate dem bi staging di next global soccer event.

FIFA president Gianni Infantino tok say dia intention na to make am really like a World Cup.”

Infantino tok say, “ dey don alreadi agree few years ago say di new 24-team men’s Club World Cup. Suppose don take place for 2021 but dey postpone am because of Covid.

Morocco don host di Club World Cup for 2013 and again in 2014, while di recent edition dey play am for United Arab Emirates for February, as Chelsea win di trophy.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *