fbpx
May 18, 2024

Niger: U.S, France don set trap for Nigeria – Adamu Garba claim

france-set-trap-for-ecowas

A chieftain of di All Progressives Congress, APC, Adamu Garba claim say di United States and France don set trap for di Economic Community of West African States, ECOWAS, to go into a total war for di region.

Also, Garba claim say any mistake of military intervention for Niger fit spell doom for Nigeria.

Hin statement dey come on di heels of di seven-day ultimatum wey dem give General Abdourahamane Tchiani. Na him be di mastermind of di supposed coup for Niger Republic, to return power to Mohammed Bazoom.

Di decision form part of resolutions wey dem reach for di emergency meeting of ECOWAS Authority of Heads of State and Government, wey dem hold for Abuja, Sunday.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu go address Nigerians today

 

Also, inside post via hin verified Twitter handle on Sunday, Garba advise President Bola Tinubu say make hin dey courageous enough to resist pressure from France and U.S for di ECOWAS to wage any military action against Niger.

Di APC chieftain call on Tinubu say make hin go for  non-kinetic and diplomatic approach.

According to am, di truth of di matter be say, West Africa don fail to protect democracy. Also, di only option now na to learn from di failures and to make sure say e no happen again.

You fit go read di tori, Garba don tok say United State and France set trap for ECOWAS…READ MORE