fbpx
May 18, 2024

BREAKING: Supreme Court Justice don kpai

supreme-court-justice-don-kpai

Justice Chima Centus (CC) Nweze of Supreme Court of Nigeria don kpai.

According to report from di TheNigerialawyer, di Supreme Court Justice Nweze kpai yesterday, at age 64.

From di information wey TheNigeriaLawyer bring, Justice Nweze been dey battling illness for di past few years, and hin health condition kon worse during dis  time.

In fact, hin health condition played role for di recent unrest among Supreme Court Justices, wey express dia concerns during di tenure of di immediate past Chief Justice of Nigeria (CJN).

As di matter be now, di South East region dey face notable absence for di Supreme Court, as Justice Odili currently retire, while Justice Ngwuta kpai two years ago.

 

FOR MORE NEWS: Transfer: Nigerian goalkeeper don join Tanzanian club, Tabora United

 

Hin na one of di justices wey stand out during di ruling on di application filed by Emeka Ihedioha, a former governor of Imo State.

Ihedioha bin ask di apex court make dem review di judgement on hin removal from office, but while di majority of di seven-man panel disagree with am, Chima Nweze.

Also, for inside hin judgment, Nweze ask di court make dem set aside di January 14 judgment wey removed Ihedioha from office, hin describe am as nullity and in bad faith.

You fit go read di tori…READ MORE