fbpx
April 25, 2024

Fuel scarcity don reach Abuja as marketers close stations

0
Fuel scarcity

Plenty fillings station bin dey close on Tuesday, he kon cause make plenty  drivers dey wait wait for di Premium Motor Spirit, wey everybody know as petrol, for the stations wey dey manage open for di neighbouring states.

Fuel scarcity don start again for di Federal Capital Territory and environs on Tuesday after about one month break, as drivers and other PMS users dey think about when dem go see the last fuel queue for Abuja.

The Fuel scarcity and di queue wey follow am start on Tuesday because of di strike wey dem start by di Suleja Depot Branch of the Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria.

YOU FIT LIKE READ THIS ONE: 5 Best Business to Start with little money in Nigeria in 2022

The oil marketers start di three-days strike on Monday and dem no gree make dia member carry fuel from the depot go more than five states for North including Abuja, this development na hin cause scarcity on Tuesday.

The two filling stations wey dey always dey busy Conoil and Total, wey dey for di front of the headquarters of the Nigerian National Petroleum Company Limited, close dia door make customers no enter on Tuesday.

Di Reason na because dem no get any petrol wey dem go sell. But, black marketers wey dey in front of the filling stations and opposite NNPC headquarters, use di opportunity take sell their market to drivers for high price

Government officials no tok anything bout this matter when dem call dem

You fit CLICK HERE go read more of di tori.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *