fbpx
April 26, 2024

Man declared missing after hin attend programme for Redemption Camp

0

One man wey many pipol know as Evans Obazee like dis like dis bin dey miss after di report reach tori pipol say him bin attend annual programme for Redeemed Christian Church of God (RCCG) camp on Thursday, December 8.

Hin family post hin picture ontop social media to notify di whole public say dem dey find am.

U FIT ALSO READ FG don express concerns over low rate of exam malpractice convictions

Di notice tok say , “Evans Isaac Obazee is missing. He was last seen in the morning, Thursday, December 8, 2022, at Redemption Camp Gate in a yellow shirt and black trousers.”

“Please any information regarding his whereabouts will be highly appreciated. 07010660019 and 07062938021. Kindly retweet.”

RCCG wey bin hold dia annual convention tagged “Double Portion” for dia campground from December 5 to December 10.

Evans elder sister Sarah Obazee tell tori pipol say dia family don make so much efforts to look and reunite with am”.

Sarah tok say dey don report di case to di church, Mowe Police Station, and di Federal Road Safety Corps.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *