fbpx
May 18, 2024

Funke Akindele mark 46th birthday with special request

funke-akindele-celebrate-46th-birthday

Famous Nollywood actress, Funke Akindele dey celebrate new chapter for her life as she mark her 46th birthday with stunning ageless photoshoot.

Also, di mother of two wey dey known for di popular sitcom, Jenifa’s Diary dey a year older today, 24th August 2023.

As she enter di image-sharing platform, Instagram, Funke Akindele celebrate her birthday with special request from her creator.

She pray for herself say she no go suffer pain again for her life. Also, she pray say na abundant and overflowing joy go dey follow her for di rest of her life.

“To God be the Glory. Happy birthday OLUWAFUNKE AKINDELE!! You will never know sorrow in Jesus’ name!! Ayo ni ooo,” Na wetin she write be dat as she share dazzling photos of herself.

 

FOR MORE NEWS: “Calm down girl” – James Brown dey beg hin senior colleague, Bobrisky

 

Also, Fans and wishers shower Funke Akindele on her 46th birthday with unending birthday wishes and prayers for her career and family.

In addition, Notable influencer, Enioluwa; comedienne Kiekie, Tonto Dikeh and plenty other celebrities add dia voice to celebrate di veteran actress.

Also, Kiekie write, “Happy bithday mama. God has given you the grace to be great and you’ll never fall short of that grace in Jesus name

You fit go read di tori…READ MORE