fbpx
May 18, 2024

Priceless moment chef surprise hardworking LASTMA official with better food

priceless-moment-chef-surprise-hardworking-lastma-official-with-better-food

Inside viral online video, one Nigerian chef reward one hardworking LASTMA official. Di chef prepare di LASTMA favorite food give am as hin dey busy with work.

Di Lagos-based chef go meet di jolly LASTMA official wey bin dey carry out hin traffic control duty.

Na so di chef ask di man say wetin be hin favorite meal, di LASTMA man reply say hin want tasty chicken with chips.

So, di chef go hin house back, and hin showed all di process wey hin follow to make di sumptuous meal.

After hin finish, hin carry am go give di man wey bin dey busy for hin work place. When di LASTMA official open di plate see wetin dey inside, hin mind sweet am well well and hin express gratitude.

 

FOR MORE NEWS: “Calm down girl” – James Brown dey beg hin senior colleague, Bobrisky

 

Netizens sef don react …

@Mayo💀 write: “Lastma sabi chicken and chips??!

@VICTOR comment: “I know this man in Lagos. If you are going to ikeja”

@Cj littles write: “This man over the years ..still the same energy

@wharskheed write: “I swear I like that man he Dey always gimme joy if am seeing him on my way to Ikeja”

@Ima-mi stated: “If you’re having a bad day and you see this man on Obafemi awolowo way, you go just happy immediately”

@user9544519327201 remarked: “God bless both of you.”

You fit go read di tori…READ MORE