fbpx
May 5, 2024

G-5 Governors no go work for Atiku – Analyst don tok way forward

g-5-governors-no-go-work-for-atiku

As di wahala for di Peoples Democratic Party (PDP) still dey tie wrapper, di Governor of Rivers state Nyesom Wike don tok say hin no dey support di ambition of di party presidential candidate, Atiku Abubakar. G-5 Governors no go work for Atiku

In fact, Wike even warn di pipo wey dey threaten am for Abuja say make dem rethink or else dem go get problem.

Hin insist say di Integrity Group of di PDP and di G-5 Governors no go support Atiku candidacy until dem do wetin hin want.

FOR MORE NEWS: Ayu neva put PDP account for public

One legal practitioner wey be political analyst, Barrister Liborous Oshoma don follow react to di matter. Hin tok say di wahala wey dey inside PDP dey beyond di G-5 Governors’ demand.

Di Barrister Oshoma yarn say hin no see any reconciliation between di PDP, Atiku and di G-5 Governors. Hin say di G-5 Governors no go work for Atiku for di forthcoming general elections.

You fit go read di full tori…READ MORE