fbpx
April 28, 2024

Ayu neva put PDP account for public

ayu-neva-put-pdp-account-for-public

Di question wey most pipo dey ask be say, why Ayu neva put PDP account for public?

Since when Ayu promise say hin go put di account of di party for public, e  don reach three months now, di National Chairman of di Peoples Democratic Party, Senator Iyorchia neva put di account public.

Na for October last year, after hin presentation to di National Executive Committee to mark di one-year anniversary of di National Working Committee, na there e bin promise say hin go put di account of di party for public.

Hin make di pledge following di accusations of mismanagement of party funds by the Rivers State Governor, Nyesom Wike.

Nyesom Wike still accuse am of illegal payment of housing allowance to members of di NWC and members of staff for di party secretariat.

FOR MORE NEWS: I go vote for Tinubu – Actress Toyin Abraham

Following di controversy Wike and his allies stong mouth with confidence say lie lie, Ayu must resign.

Wike and hin paddy, di Benue State Governor, Samuel Ortom; Oyo State Governor, Seyi Makinde; Abia State Governor, Ikeazu Ikpeazu; and Enugu State Governor, Ifeanyi Ugwanyi, stand dia ground say for equity justice and fairness di national chairman must step aside for another southern chairman.

Di Rivers governor accuse Ayu say hin pocket N1bn wey Lagos businessman bin donate, because dem say hin no remitt am to di party treasury. But di senator Iyorchia Ayu deny am.

When some reporters ask for di reason Ayu neva put PDP account for public as hin promise, di Special Adviser on Media and Communications to di National Chairman, PDP, Mr Simon Imobo-Tswam, yarn say hin neva get details from hin principal.

You go like read di full tori…READ MORE