fbpx
May 19, 2024

Gunfire for Gabon as soldiers seize power, cancel election result

gabonese-soldiers-end-regime

Dozen Gabonese soldiers appear for television on Wednesday and dem announce say dem wan end di current regime and dem wan cancel election wey, according to official results, tok say na President Ali Bongo Ondimba win.

During di announcement, AFP journalists hear gunfire for di Gabonese capital, Libreville.

As dem announce di cancellation of di results, one of di soldiers yarn say all di institutions of di republic no dey again.

One of di soldiers tok on top TV channel Gabon 24 say dem don decide to defend peace by ending di current regime. Also, hin add say hin dey tok on behalf of di “Committee for di Transition and Restoration of Institutions”.

Hin add say di general elections of 26 August 2023 and di truncated results don cancel.

 

FOR MORE NEWS: Refuse dumps for Apapa-Oshodi Expressway no dey acceptable — Works Minister

 

Among di soldiers, members of di Republican Guard as well as soldiers of di regular army and police officers follow dey there.

Also, di statement broadcast for Gabon 1 public television.

AFP journalists hear gunfire for different districts of Libreville during di statement.

Di announcement come shortly after di national election authority yarn say Bongo, wey dey in power for 14 years, bin win third term for Saturday election with 64.27 percent of di vote.

You fit go read di tori see why Gabonese soldiers end di current regime…READ MORE