fbpx
May 19, 2024

Passport Queues Must Stop- Interior Minister warn Embassy

tunji-ojo-order-agency-heads

Olubunmi Tunji-Ojo, di interior minister, don order di agency heads make dem find solution to make passport application and collection process fast.

“Nigerians no suppose to dey wait for long lines to collect passportsTunji-Ojo yarn say dat kain thing must end. Hin tok dis one inside statement on Wednesday wey Chief Press Secretary to the Minister of Interior, Alao Babatunde release.

Di minister add say President Bola Tinubu no get any use for justifications and hin advise di agency heads make dem act in accordance with dia words because di nation dey for crossroads and di nation desperately need reform.

 

FOR MORE NEWS: 11-year-old boy, Joshua Fred, don win Lagos government award for coding calculator

 

Another point wey Tunji-Ojo make as hin order agency heads na di use of technology to improve accuracy and efficiency for immigration and correctional services.

As hin dey tok for brief with di Acting Comptroller General of Immigration, Adepoju Carol Wura-Ola, and Controller General of di Nigerian Correctional Service, Haliru Nababa, di Minister repeat di order of His Excellency, President Bola Ahmad Tinubu, to get all hands on deck.

You fit go read di tori….READ MORE