fbpx
May 19, 2024

Refuse dumps for Apapa-Oshodi Expressway no dey acceptable — Works Minister

minister-condemn-apapa-oshodi-expressway

Di Minister of Works, Senator David Umahi, yesterday condemn how di reconstructed Apapa-Oshodi Expressway take be. Dis na after hin see how di place don turn to refuse dumps along di median between Tin Can Port and Mile-2 of di ever-busy dual carriageway.

Hin yarn say e dey bad to see as di expressway don turn to refuse after dem speng huge sums of money to reconstruct am to di present state.

Di Minister tok how hin feel about di road during hin inspection of some ongoing federal projects for Lagos.

Also, hin describe di situation as unacceptable, and hin promised to discuss with Governor Babajide Sanwo-Olu of Lagos State over di matter.

 

FOR MORE NEWS: Governorship election: APC disown Campaign Council lists for Imo, Bayelsa, Kogi

 

Umahi, wey bin reveal say all road projects during hin tenure as minister go be concrete, note am say concrete roads get longer spans.

Hin yarn say hin dey ready to fight with contractors wey dey handle federal road projects over concrete technology because of di durability and sustainability”.

In addition, hin yarn say dem go complete Lagos-Ibadan expressway by mid-Sept.

Di Apapa-Oshodi Expressway na road wey don dey news for years because government abandon am.

You fit go read di tori see why works Minister condemn Apapa-Oshodi Expressway…READ MORE