fbpx
May 17, 2024

Ghana Police don issue fresh warning ontop anything call “New year prophecies”

Ghana Police don come out give beta warning to all Ghanians over anything call new year prophecies say dey no wan hear am at all.

Dey tok say dat order no bi seresere oo say e dey very active, and if dem see anybody wey wan go against am di persin cup go full remain.

U FIT ALSO READ Burkina Faso no fit expel official – UN chief

As at last year police bin ban new year prophecies inside religious organisation most especially churches, as dey describe am as misleading word to pipol.

Police pipol tok say such prophecies dey capable of making pipol to panic and more likely to endanger dia lives.

Base on say dey give di order of banning anything call prophecies last year di police don make pipol understand say di thing never change ooo.

Police spokesperson, Grace Ansah-Akrofi yarn dis one inside one of hin statement say,“ since di year 2022 dey move to an end, dey wish to once again announce to di general public, especially churches to ensure say dey comply with di law wey relate to communication of prophecies,”

To read di full tori CLICKHERE