fbpx
May 18, 2024

FG advise Parent Make dem Allow Health Workers Deworm Children

FG-advise-parents-make-health-workers-deworm-children

Di Federal Government on Wednesday for Abuja advise parents and caregivers make dem allow health workers  administer deworming drugs to Deworm  children for di prevention of Neglected Tropical Diseases (NTDs).

Dem make di call during di community outreach for di treatment of schistosomiasis and soil-transmitted helminthiasis.

Helminthiasis na infestation with one or more intestinal parasitic roundworms wey include whipworms, hookworms and ascaris.

While dem dey give di advice, Mr Fatai Oyediran, Director, Snake Envenoming Unit, NTDs Division for di Ministry of Health, criticize di poor response by parents. Hin yarn say parents suppose allow Allow health workers deworm children with di mass drug administration to prevent NTDs.

Additionally, Oyediran mention say di NTDs dey always affect pipo for rural communities, especially di poor. Di reason na because of poor personal hygiene, inadequate water supply and infrastructure for di grassroots.

FOR MORE NEWS: Traders dey lament as Okowa shut down markets for Atiku

Some of these diseases dey affect children under di age of five and na why Oyediran yarn say dem target communities and schools to give free drugs.

And now, FG dey advise parents make dem cooperate with health workers because some parents, because of personal or religious beliefs, no dey allow dia children take di drugs e dey cause more damage than good.

Furthermore, Dr Eunice Ogundipe NTDs Coordinator in the FCT, for hin remark yarn say di outreach and di NTDs Day celebration na call for all stakeholders to collaborate so that dem go fit eliminate di diseases.

You fit go read di full tori…READ MORE