fbpx
May 17, 2024

Traders dey lament as Okowa shut down markets for Atiku

traders-dey-lament-as-okowa-shut-down-markets-for-atiku

Traders for Delta State dey lament bitterly as di Okowa shut down di popular markets for di state on Tuesday for Atiku.

One of di popular markets, Ogbogonogo Market for di  Asaba metropolis, dey shut down and na di directive of Governor Ifeanyi Okowa because of di presidential campaign rally of di Peoples Democratic Party wey dem hold for di state on Tuesday.

Some traders yarn say dem lose money because of di visit of di PDP presidential candidate, Atiku Abubakar, for di state.

Di Traders lament about wetin e cost dem for separate interview. Dem describe di attitude of di state government Okowa towards di citizens’ welfare as insensitive.

FOR MORE NEWS: Nigerians get another alternative instead of PDP and APC – Kwankwaso

“Markets yarn say Okowa shut down dia market on Tuesday for dia party campaign, and na why Okowa no declare public holiday for civil servants. Dem yarn say di workers dey there dey work for am but hin closed dia only source of income.

On top di matter, Mordi, wey be one of di traders ask weda di Governor no know say e get people wey dey go hungry if market open for one day.

As di traders dey lament, dem tok  say Okowa for no shut down dia markets because of Atiku

However, as Atiku bin dey address di party supporters for di venue of di rally, di Stephen Keshi Stadium, Atiku yarn say hin no come with hin team to Delta for campaign. Hin yarn say hin come thank di state.

Atiku yarn say since 1999, Delta never fail to support dia party, and na why hin chose hin running mate, Okowa, from there.

You fit go read di full tori…READ MORE