fbpx
May 5, 2024

Herbalist give customer belle for Kano

Herbalist give customer belle for Kano…..Wahala in portable voice. Nothing wey Musa no go see for gate, nah him be dis matter wey just happen so.

Kano Hisbah officials don go arrested one herbalist wey him name be, Muhammad Mansur, on to say he gives hin customer wey come for treatment belle.

The herbalist wey dey lives in Kode town, Dawakin Kudu Local Government Area of the state of the LGA, don enter hisbah wahala as dem don arrest him on to say he give him customer belle and the belle don reach seven month but he be like say the herbalist no wan collect the belle.

According to wetin the woman yarn, the herbalist dey popular for this kind matter, to deceive women sleep with dem, especially married women wey dey look for kayamata wey go make dia husband like dem and no look other woman face.

Herbalist lie to sleep with me (herbalist give customer belle)

The woman go the hisbah office go report the matter, she talk say, she go the herbalist place for treatment but he talk say the medicine no go work until he sleep with her.

She add join say the man don dey fine how he wan take sleep with her since he don dey go the place but because say he dey always go dia with her mama, he no succeed until the day she waka go dia alone. Anytime wey I follow my mama go the herbalist place, he go tell me say make I dey come alone.

So I wan make hisbah helep me put mouth for the matter because he dey try reject belle wey don reach seven month now.

After Hisbal police gbab the man, the herbalist gree say nah him carry belle give the woman and nah the work of the devil.

According to the man, Nah true say she came to my place for medication…but as you know say devil no get house nah everywhere he dey. I gree say I don commit offence but may Hisbah forgive me, he beg.

Meanwhile, the LGA Hisbah Commandant, Ustaz Kabiru Musa Dawakiji, said their head office go handle the matter

You go like read: No put old Naira Note for ATM again – CBN