fbpx
April 23, 2024

HIV infected woman call radio station confess say she dey always mix her blood with di zobo drink wey she dey sell

0
HIV-mix-with-zobo=drink

One anonymous character called radio station share di kain thing wey she don dey do after dem confirm her HIV status for hospital.

For inside di episode of ‘MARKETRUNS’ with radio OAP, Emadomi Wilson Eguakhide wey pipo sabi as RATATA and Sosorobia for Wazobia FM, one unidentified woman call di radio confess say she bin dey mix her HIV infected blood with di zobo drink wey she dey prepare before she carry am go sell for people for di past six months.

YOU GO LIKE READ:11 Home Safety Tips to Keep Your Family Safe

Before she called, Ratata tell people say make dem call di radio line and make dem share those suspicious things wey dem don do for dia past and dem no dey proud about am.

Hin tell people make dem call so that dem go share those terrible things wey dem don do for dia market places whether dem dey sorry or dem no dey sorry about am.

Na for inside The Nation this tori dey o, hmm wetin musa no go see for gate…READ MORE

For more news: I dey spend at least N2m everyday– Ashmusy

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *