fbpx
April 18, 2024

Pipol of Anambra please Pay your tax – Soludo begs

0

Anambra state Governor Chukwuma Soludo dey beg indigenes and residents from other states wen get properties for Anambra to con pay dia tax to di state government.

Soludo tok say if dem want beta administration wen go deliver better social services to di pipol of di state make dey do di needful.

U FIT ALSO READ Illegal levies, forex crisis dey disturb fuel supply – Marketers

Di former Central Bank Governor yarn dis one on Thursday during di presentation of di state 2023 Budget for State House of Assembly in Awka.

Soludo tok say despite say Nigeria get poor tax payment culture, Anambra na one of di least state with a very poor tax revenue.

Pipol of Anambra, pay your tax biko.dat is how it works everywhere,”soludo begs Na only you pipol fit make me put di necessary infrastructure in place for di state if una dey pay tax well well

Hin tok say “Anambra na one of di state with di least tax revenue in di world. compare to Lagos state.

Lagos State generate N1.1tn from IGR in 2023 coming to almost N100bn a month…Anambra’s IGR no fit reach 4.4% of Lagos State IGR.”for 2023

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *