fbpx
May 9, 2024

Weeks after presidential election, plenty pipo dey homeless as rainstorm blows off 105 buildings for Ekiti

homeless-pipo-ekiti-rainstorm

Plenty pipo don turn homeless after di heavy rainstorm wey destroy more than 105 buildings for Oke-Ako, Ikole Local Government Area of Ekiti State on Friday, March 3.

Di downpour wey start about 3pm follow destroy some electricity facilities across di town, and dat one don subject di residents to total blackout.

While on a visit to di affected area on Saturday, March 4, di deputy governor of di state, Monisade Afuye, describe di incident as highly devastating.

A statement by di Special Assistant Media to di Deputy Governor, Victor Ogunje, on Saturday, quote di Governor as hin express hin happiness say dem no lose any life during di rainstorm wey render plenty pipo homeless for Ekiti.

FOR MORE NEWS: “Dis Girl Dey Give Dis Man Joy”- Reactions As Video of Paul PSquare in Church With His New Babe

On behalf of his Excellency, Governor Biodun Oyebanji, I sympathize with you on di destruction wey rainstorm cause to plenty residential buildings and electricity poles for dis town. And we believe say wetin happen fit don affect di wellbeing of di victims.

Information wey we get reveal say oofs of scores of residential buildings and electricity facilities dey destroyed during the stormy rainfall, and e render plenty pipo homeless and helpless. We sympathise with di victims for these trying times and plead for calmness. Dis na some of di tok wey dey inside di statement.

You fit go read di full tori…READ MORE