fbpx
April 27, 2024

Election result: Allow cameras at hearing – Joe Keshi don charge Supreme Court

joe-keshi-don-charge-supreme-court

Joe Keshi, wey be retired ambassador, don appeal to di Supreme Court. Hin tell dem say make dem allow cameras inside court for di first time when di hearing for di Presidential election start.

Di Labour Party, LP; di Peoples Democratic Party, PDP; and di New Nigerian Peoples Party, NNPP don ready. Also, all of dem don vow to approach di court following di outcome of February 25 Presidential and National Assembly elections.

Bola Ahmed Tinubu of di All Progressives Congress, APC, bin dey declared as di winner of di election. Dis na for di miidle of di outcry of rigging, and manipulation of votes by politicians across di kontri.

FOR MORE NEWS: 2023 election results: INEC Certificate of Return be like World Cup – Tinubu

 

Keshi, wey be ambassador to many kontries, including Togo, Ethiopia, Belgium, di Netherlands, Namibia, Sierra Leone and di United States, don chook mouth. He yarn say make di Supreme Court allow di process dey transparent dis time.

Joe Keshi drop dat update for Supreme Court on top Arise Television The Morning Show.

Also, he yarn say e go good make Nigerian pipo follow di process. If dem do am like dat,  at di end of di day, Nigerians go dey satisfied with di judgment wey dem give.

You go like go read di full tori…READ MORE