fbpx
April 26, 2024

Usain Bolt don fire hin business manager after $12.7 million miss for inside massive fraud case

usain-bolt-fraud-case

Jamaican sprinter, Usain Bolt don express hin shock over how $12.7 million of hin money go missing from local private investment firm, wey authorities dey investigate as part of massive fraud case.

As Bolt dey follow reporters tok, hin yarn say he don sack hin business manager and e add say di split no dey friendly.

According to Usain Bolt attorneys on di fraud case, hin account with Kingston-based Stocks and Securities Limited suddenly drop from around $12.8 million to just under $12,000.  As di matter be now, di corporation get until Friday to repay di money, and if dem fail to pay am, dem go take legal and criminal action.

Also, Attorney Linton P. Gordon yarn say make di public prepare for both di “expected and di unexpected” for this case. Hin follow di Jamaica Observer newspaper yarn this one.

FOR MORE NEWS: Container-laden Truck Don Fall On Top Commercial Bus For Lagos, 9 Pipo Don Kpai

Earlier this week, Jamaican Finance Minister Nigel Clarke announce say di director of di Financial Services Commission go step down and say di Bank of Jamaica go dey in charge of regulating di island financial system.

He yarn say in addition to several government organizations, di suspected scam also affect senior citizens.

Di Jamaican officials don ask for assistance from di FBI and other unnamed foreign specialists wey follow claim say di consumers bin receive wrong information about dia balances as part of di suspected scam. Officials neva tok di exact number of clients wey e affect of di amount of money wey dem lose.

Bolt mention di suspected scam as hin dey tok for luncheon.

You fit go read di full tori…READ MORE