fbpx
March 19, 2024

Hoodlums don destroy voting materials for Bayelsa

hoodlums-destroy-voting-materials-for-Bayelsa

Some Hoodlums don hijacked and destroy voting materials wey dey for di House of Assembly election for Wards 2, 3, 4 and 5 inside di constituency five of di Ogbia Local Government Area of Bayelsa State.

Governor Douye Diri don strongly condemned di act of hoodlums wey destroy voting materials for Bayelsa, dis na according to hin Chief Press Secretary, Mr Daniel Alabrah.

Di governor advise di Inspector General of Police and Commissioner of Police for Bayelsa state make dem restore peace for di area.

FOR MORE NEWS: Shooting Stars don sign Olamilekan from Lobi Stars

Meanwhile, accreditation and voting bin neva start for wards polling units 14, 15, 16, 17, 18 and 19 for Atissa Constituency, Yenagoa LGA of Bayelsa State as of 9 am.

According to observations, INEC officials and balloting materials neva comot for di Atissa RAC as of 8:45 am.

Also, dem see Buses and other vehicles wey dey loaded with voting materials to depart for polling units for di area.

You fit go read di full tori…READ MORE