fbpx
April 25, 2024

Papa sell hin 9-month-old son to three different buyers for Ogun

One-man-sell-his-9-month-old-son-for-Ogun-state
Operatives of di Amotekun police don arrest one 30-year-old man wey sell hin son for Ogun State. Di name of di man na Daniel Chigozie.
In addition, di Police arrest am for claims of selling hin son to three different buyers for Ogun State.
Also, di Commandant of di police for Ogun State, David Akinremi yarn say di security agency get information say di papa sell hin 9-month-old son, Daniel Chinonye Darlington to three different buyers. Di different locations wey hin sell di pikin na Sango, Meiran and Apapa area of Lagos.
E dey gathered say di suspect collect  N150,000, N400,000 and N700,000 respectively. Hin collect am from unknown buyers between August 2022 and February 2023.
Di suspect wey dey live for Abela, Sango-Ota, for Ado-Odo Local Government Area of di state, confess to di crime, di man tok say hin sell hin son for Ogun state.
As di matter be now, di National Agency dey profile am for di Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) for follow-up investigation to recover the pikin and for prosecution.
You fit go read di full tori…READ MORE