fbpx
May 19, 2024

FG go unveil humanitarian fund for poverty alleviation – Edu

humanitarian-funds-poverty-alleviation

Di Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Dr Betta Edu, yarn say di government go soon unveil di Humanitarian funds to lift 133 million Nigerians out of poverty.

She reveal dis update during Channels Television interview on Friday.

Also, based on report, on Monday Edu yarn say di the government go lift 133 million Nigerians out of poverty.

When pipo ask how she plan to achieve di target, she explain say she go unveil humanitarian funds.

 

FOR MORE NEWS: Priceless moment chef surprise hardworking LASTMA official with better food

According to her, di government go dey transparent and sincere with Nigerians on dia plans and agenda.

“Presently, dem dey work to put di plan to action. And, President Bola Ahmed Tinubu don set di agenda already.

“From a humanitarian trust fund, dem go mobilize funds across di board. Di federal government, private sector and international organization.

Also, she yarn say dem go dey very transparent to Nigerians; di target na to lift 133 million Nigerians by 2030.

In addition, di National Bureau of Statistics Poverty Index yarn say about 130 million Nigerians dey poor.

You fit go read di tori of di Humanitarian funds wey dem wan use for Poverty Alleviation for Naija…READ MORE