fbpx
May 18, 2024

BREAKING: Tears as Nigerian military bury 22 officers wey kpai for Niger

military-personnel-kpai-for-niger

22 military personnel wey die during combat for Niger State finally enter ground today for di National Military Cemetery wey dey Federal Capital Territory, FCT, Abuja.

According to report, di Defence Headquarters (DHQ) on August 14, announce di death of at least 36 officers wey kpai for battle.

Some insurgents for di Zungeru area of Niger State bin shoot down di officers helicopter.

 

FOR MORE NEWS: NNPP announce suspension of two members

 

Also, e neva too tey wey dem deploy di troop to Kundu village for Wushishi Local Government Area after bandits terrorize di area.

dI families of some of di deceased officers don go carry di body bury am, and now, na 22 remain wey dem bury on Friday9today).

Minister of State for Defence, Bello Matawalle, Chief of Defence Staff, Major General Christopher Gwabin Musa, and other service chiefs dey for di cemetery now.

You fit go read di full tori of di Military personnel wey die for Niger...READ MORE