fbpx
March 28, 2024

I don construct more roads dan any governor for di history of Ogun state – Dapo Abiodun

0

Governor of Ogun State Dapo Abiodun of Ogun State don come out tok say for history of di state na only hin own administration construct more roads dan any administration before him.

Hin tok say make dem check all hin predecessors like Ibikunle Amosun, Gbenga Daniel and Segun Osoba wetin him don do concerning road mata dem no do half of hin own.

U FIT ALSO READ Gbasgbos: Professor Do your Own, I Don Do Mine – Peter Obi Yab Soludo

According to Governor Abiodun, hin tok say hin don do over 80 major roads for di state including federal road, since hin come into power as governor in year 2019.

Abiodun tok say di road wen hin administration don do both new ones and old ones wen hin repair if dem calculate di road by kilometers, hin administration don do up to 400km, since 2019 till now

Hin administration in three years and six months don do more of roads dan previous administrations for di State,” Gov Abiodun yarn dis one on top one post for hin social media handle

To read di full tori CLICKHERE.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *