fbpx
April 25, 2024

Atiku, use Ogun swear if you no fight Obasanjo -Tinubu

0

Presidential candidate of di ruling All Progressives Congress, APC, Asiwaju Bola Tinubu don accuse Atiku Abubakar,wen bi presidential candidate for di Peoples Democratic Party, PDP,say hin fight di former President Olusegun Obasanjo wen hin serve as vice president.

Atiku Abubakar bin serve sa vice president under di Obasanjo administration beetwin 1999 and 2007.

U FIT ALSO READ Atiku and Okowa meet Jonathan for Abuja

Tinubu, yarn dis one during di flag-off of di Delta APC governorship campaign for Warri on Saturday,hin tok say if Atiku feel say wetin hin tok na lie make Atiku con use ogun swear.

Tinubu tok say leaders wen suppose to dey think on how everything go dey go ciriri werere for pipol of di countri, con dey fight dia self, seh dem no dey same, as old as dem bi, no bi wetin good at all.

Hin tok say wen Atiku still dey vice Obasanjo, hin con dey fight hin oga for public. Con dey open dia yansh on how dem take spend money,buy car give dia girlfriends.tinubu con ask pipol say seh na those kind of pipol una still wan vote for to become Nigeria President.

Tinubu carry hin hand beat hin chest give Nigerians say hin dey assure dem say di APC administration go deliver all di promises wen dey don promise Nigerians if dia party win for next year election.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *