fbpx
April 24, 2024

I don finish my earthly ministry, and I go soon d!e — Prophet Odumeje announce

odumoje-tok-say-he-go-soon-die-and-hin-reveal-say-hin-don-complete-hin-mission

Controversial Anambra-based pastor, Chuwkuemeka Ohanere, wey dey known as Odumeje, don reveal say hin don complete hin visit mission on earth and hin go soon die.

Di clergyman full every wia for internet kon dey viral because of hin strange personality and strange pattern of conducting spiritual deliverance for hin church.

He make headlines in July 2022 after hin church wey dey located for  Bida Road, Fegge, Onitsha, Anambra State, bin almost dey demolished by di Anambra State Government (ANSG) task force.

Inside new development, Odumeje, reveal to hin church members during sermon say hin don complete hin mission on Earth and e go soon go back.

He yarn say hin don tell hin son to take care of hin wife and siblings when he die, because hin time don near.