fbpx
April 28, 2024

I go Break Tinubu ‘Monopoly’ for Lagos – Adediran

i-go-break-tinubu-monopoly-for-lagos-adediran

I go Break Tinubu ‘Monopoly’ for Lagos – Adediran

Olajide Adediran, wey dey popular as Jandor don vow to end di thing wey hin call di 24-year monopoly of former governor of di state, Asiwaju Bola Tinubu. Olajide Adediran na di

Governorship candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) in Lagos State.

For December 2021, hin abandon APC because of di dominance of Asiwaju Bola Tinubu.

For Channels Television Sunrise Daily programme yesterday, Adediran yarn say di problem wey Lagos get be say na only one head dey think for di state of Lagos. And na so e don be for di past 24 years,”

FOR MORE NEW: Election go hold as scheduled, Buhari don tok

Hin accuse Tinubu, di 2023 Presidential candidate of di All Progressives Congress (APC) say na him start di removal of “performing governors” for di state.

Former governor Babatunde Fashola bin survive di attempt as dem bin wan remove am for di year 2011. Hin get luck return for second term. But di man wey follow am, Akinwunmi Ambode bin no fit survive am, na why dem remove am after one term for 2019.

Hin assure Lagos electorate say hin go bring decentralise developments for di 20 local government areas of di state if dem elect am for di election wey dey come so.

Adediran yarn say for dia first year in office, dem go do plenty things for Lagos. Dem go come as independent government; di one wey no dey tied to anybody.

For them to achieve wetin dey dia plan, Adediran don say hin go break Tinubu monopoly for lagos.

You go like go  read di full tori…READ MORE