fbpx
April 27, 2024

Local printers go sue INEC – Ballot paper

Local-printers-go-sue-INEC

Di Independent National Electoral Commission fit enter court wahala with Nigerian printers under di Chartered Institute of Professional Printers of Nigeria because dem dey print electoral materials overseas. Local printers go sue INEC.

Di agency yarn say e dey illegal and na violation of di CIPPON Act 24 of 2007 of di Federal Republic of Nigeria.

Dem charge di council with di duty of regulating, controlling, managing and administration of printers, di business of printing and other printing related-matters for Nigeria.

From di interview with di President of CIPPON, Mr Olugbemi Malomo, hin admit say di electoral body don dey award printing jobs to local printers.

 

FOR MORE NEWS: Insufficient funds dey slow Lagos-Ibadan Expressway construction – Fashola

 

Malomo explain say by law, INEC suppose award di printing of all electoral materials, including ballot papers to local printers through CIPPON.

Hin cite Section 23b of di CIPPON Act, wey state:

 

“In regulating the registration of printing practitioners, di council ensure say no firm or partnership go practise as printers for Nigeria unless e dey registered by di council.’’

Malomo yarn say improvement dey for di awards of contracts to Nigerian printers after di CIPPON council visit di INEC Chairman, Mahmood Yakubu, for Abuja last year.

As Local printers go sue INEC, go read di full tori about di matter…READ MORE