fbpx
May 18, 2024

Subsidy removal: Expert warn Nigerians wey dey convert generators from petrol to gas

nigerians-convert-generator

Nigerians don become more innovative as dem dey convert generator from petrol to gas following di removal of fuel subsidy by President Bola Tinubu on May 29.

Tinubu sudden decision to stop di oil subsidy regime make price of petrol increase. Di price wey petrol dey sell before na N200, and now di petrol price dey sell for above N600 per little.

Di increase in fuel price don affect di cost of transportation, also, both tangible and intangible goods.

Even as government dey look for ways to reduce di cost of transportation through di conversion of petrol buses to di ones wey dey use Compressed Natural Gas (CNG), di authorities no pay attention to electricity power generators.

Naija still dey suffer from power problems. Also, as di matter be, Naija get di lowest access to electricity globally, with about 92 million persons out of di kontri 200 million population wey no get access to power, according to di Energy Progress Report 2022, wey Tracking SDG 7 released.

 

FOR MORE NEWS: Singer D’Banj gift N2 million to woman inside viral $1 lottery video

 

According to reports, Naija power grid dey always collapse at regular intervals, and dat matter dey leave some communities in darkness for days.

To enjoy electricity for dia house, Nigerians don decide to use alternative power sources, di cheapest wey fit power generators of different sizes.

Generators wey pipo dey run with premium motor spirit, don become something wey di poor masses no fit afford again.

Expert don clear pipo say do dey run generator with gas fit cause explosion if dem no maintain and monitor am well. Also, experts yarn say na where di government need to come enlighten di masses.

Infact, some don suggest say Nigerians need to chose solar as dia alternative source of energy instead make dem convert generator wey dey use petrol to gas.

You fit go read di full tori…READ MORE