fbpx
April 18, 2024

Indefinite strike: FG don call varsity councils, vice-chancellors as parents dey complain.

0
Osodeke\and\Adamu

The Federal Government don invite pro-chancellors, vice-chancellors and chairmen of governing councils of federal universities come meeting for Abuja on September 6 as part of action to take settle the continuous strike by the Academic Staff Union of Universities.

Na National Universities Commission call everybody together for the meeting. Dem talk say all the people wey dey involved, go look into the matter of government action for the strike matter.

The letter wey dem use invite the heads of the universities come the meeting bin dey approved by the NUC Deputy Executive Secretary, Administration, Chris Maiyaki and na one reporter collect am on Tuesday.

 

You fit also like to read this one: ASUU don announce endless strike ‘after fruitless talks with FG’

 

Stakeholders, especially the parents, for different interviews with The PUNCH, dey talk say ASUU and the government no do well, dem dey cry say dem dey use dia pikin future dey play.

The calculation wey one reporter do, show say one session dey close to nine months; divided into first semester, wey dem dey call harmattan semester and the second semester na rain semester. Most Nigerian public universities, on the average, dey spend nine months per session.

Na since February 14 ASUU don start the strike because of wetin dem call “failure” on the part of the government to meet dia demands.

You fit go read more of this tori for here, CLICK HERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *