fbpx
May 5, 2024

Wike Drop Strong Hints on di Presidential Candidate wey hin go Support as Makinde Allegedly Takes Decision

Wike-drop-strong-hints-during-rally

Governor-Wike-Seyi-Makinde-

Wike drop strong hints on di presidential candidate wey hin go support. Di person must get di quality of not canceling any agreement, and hin must keep to hin word. Na wetin di oga of G5 governors tok be that.

Rivers state governor Wike Drop Strong Hints on who he wan support on Wednesday, January 18, for Rumuji-Odegwe town.

Di Rivers chapter of di Peoples Democratic Party (PDP) bin hold rally to inaugurate di campaign for Emohua Local Government Area.

Hin tell one PDP stalwart, Ohna Sergeant Awus say make hin exercise patience. This na after di stalwart tell Wike say di party stalwarts for di state dey wait for hin directive on di presidential election.

FOR MORE NEWS: Tinubu wife to Nigerians – “pursue my husband comot if hin no perform well”

Governor Wike tell di PDP leaders for di  rally that say hin go soon conclude negotiation with hin political allies, after everything,  hin go tell them about hin decision.

With confidence, hin tok say Rivers state go play frontline role to decide on di next president of Nigeria.

Hin add say hin dey wait for di pipo wey threaten to expel am from di PDP make dem come.

Report tok say di Oyo state governor, Seyi Makinde, go lead di presidential campaign rally of Atiku Abubakar for Ibadan.

Governor Makinde wey be member of di G5 governors follow get serious diagreement with di PDP flagbearer.

You fit go read di full tori…READ MORE