fbpx
May 5, 2024

Tinubu wife to Nigerians – “pursue my husband comot if hin no perform well”

Tinubu-wife-to-Nigerians-she-dey-charge-Nigerians-for-rally-

Update don come from Tinubu wife to Nigerians. Oluremi, wey be di wife of di All Progressives Congress, APC, presidential candidate, Bola Tinubu yarn say make Nigerians reject her husband if he fail to perform if dem elect am as president.

She give di charge for South-East women rally for Tinubu/Shettima Presidential Campaign for Owerri, Imo State.

Tinubu, di former Lagos State governor sef don tok say di February election go mainly center around performance with di fear of God and no be religion.

FOR MORE NEWS: Governors of di 36 states plan to meet di CBN, Godwin Emefiele

Hin follow  advise Nigerians make dem give di APC Muslim-Muslim chance after dem vote for Christian-Christian

Tinubu Wife yarn say she be Christian, she kon ask Nigerians weda dem don think am before say one day Christian-Christian candidate go come out be presidential candidate.

She yarn say Nigerians don try di Muslim-Christian ticket, make we try Christian-Christian now.If after four years, dem no do well, make Nigerian pursue dem comot.

You fit go read di full tori…READ MORE