fbpx
May 5, 2024

“Shebi She No Need Husband?” Reactions As Ini Edo Flaunt Engagement Ring

ini-edo-news-of-engagement

Nollywood actress, Ini Edo don shake internet with di news of her engagement.

Di mother of one and chocolate-skin beauty reveal her engagement via her Instagram story.

Ini announce say na Jesus Christ na hin engage her as she dey show off her engagement ring.

Di video don spark debate, and e don make plenty pipo dey wonder if di movie star dey too old to marry.

“Just dey play, you don suppose enter menopause by now,” one Nikki Devin Conn write dat one for her comment session.

 

FOR MORE NEWS: “She don high” – Ini Edo cause buzz with new dance video

 

“I think say she no need husband before now,” one Olorunloba Zion write that one. She neva change her mind.

One Journopeace write, “I think say ndiifenemeniso yarn say men no be di price.

We don’t need Men’ yen yen yen. But when dem dey engaged or bag one man dem go wan show di whole world.

One Sultry Shades of Beauty write, “Congratulations o, make e no be person husband Sha. Dat one don become pattern with una actresses”.

Remember say Ini Edo bin marry one Edo businessman, Philip Ehiagwina in 2008, but di marriage jamb rock in 2014. The mother of one since dat time welcome one pikin through surrogacy.

You fit go read di tori see di matter wey Ini Edo news of engagement carry come….READ MORE